9 If yu nor dey obey di law, God nor go hear yor prayers.
Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
If I gada sin for my heart, God nor go ansa or listin to mi.
Wiked leaders go fit sey God dey dia side? Leaders wey dey use di laws take opress pipol!
God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont.
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
God nor like wen wiked pipol dey offa sakrifice gi-am, bikos dem dey do am with bad belle.
Una with evritin wey una dey do, nor mean anytin. Na yeye pipol dey woship una!
Even if dem fast, I nor go listin to dia kry for help and if dem offa burnt and korn ofrin, I nor go asept am. Instead I go kill dem for war and with diziz and honga.”
Wi know sey God nor dey listin to anybody wey dey sin, but if pesin dey do wetin God tok, God go hear en prayer.