28 Pipol dey hide wen wiked pesin dey rule, but wen e nor dey again, raitious pipol go prosper.
Dem hide am for God Temple for six years wen Atalaya dey rule di land.
For evry aria for di kingdom where dem for read di kommand, di Jew pipol for der go take holy day kon do party with happiness. In-short, many pipol kon turn to Jew, bikos dem dey fear di Jew dem naw.
Dem nor let poor pipol get wetin dem suppose get and doz wey nor get at-all, dey run go hide.
Wen good pipol dey rule, evribody dey happy, but wen bad pipol dey rule, evribody dey hide.
Make yu dey always give tins to poor pipol and yu nor go ever lack, but if yu nor dey sorry for poor pipol, dem go curse yu.
If yu nor dey gri take korreshon, one day yu go fall and yu nor go fit stand again.
Make yu show mi good ruler and I go show yu happy pipol. Make yu show mi wiked ruler and I go show yu pipol wey dey komplain.