25 To get long-trot dey only kause trobol, so e betta make yu trust God.
My Oga wey bi God for Heaven Sojas, make Yu si di blessing wey dey follow doz wey trust Yu.
Na only trobol bad belle dey kause, but love dey kover evry sin.
God nor go let honga kill good pipol and E nor go allow wiked pipol get wetin dem wont.
Make yu dey give and yu go prosper; help odas and yu go get help.
To dey karry body up, dey kause wahala, but doz wey dey take advise, wise well-well.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
Long-trot dey kill pesin family finish, but doz wey hate bribe, go get long life.
Happiness dey bring joy to pesin heart and good news dey make pesin happy.
Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
If una porshu proud pipol komot from where una dey, kworel, wahala and bad words, nor go dey again.
Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.
E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.
Den I go always guide and satisfy una with good tins. I go make una dey strong and well. Una go bi like gardin wey get plenty wota and like wota wey nor go ever dry.
To live as God wont and dey happy with wetin E give yu, dey bring betta reward.