19 Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem.
Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
If pesin nor get melu wey go work for en farm, food nor go dey for am to chop, but strong melu wey sabi work, go make yor korn plenty.
If na so-so sleep yu dey sleep, na poverty go kill yu. But if yu dey work hard, yu go get plenty food to chop.
but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.
Dem gi-am 70 pieces for silva from Baal temple and e use am take go hire wiked men wey nor dey obey di law.