For dat time, Menahem from Tirzah attack Tifsah. E kill evribody wey dey di town and doz wey dey stay near di town, bikos dem nor gri surenda. Even wimen wey get belle for der, e kut dia belle open.
Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
Dem vex skata and kill pipol for oda kountries and dem nor dey taya. Dem vex rule oda kountries as dem like kon dey opress di pipol and e nor taya dem.
Wen Herod si sey di wise men deceive am, e vex well-well, so e send sojas make dem go kill all di boys wey don rish two years kom down, bikos e don rish two years wen di wise men kom meet am sey, dem si di star.