But Onan know sey di pikin nor go bi en own. So wen ever e dey sleep with en broda wife, e dey kwik get up, so dat e nor go born shidren for en broda wey don die.
Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.
But di Jew pipol dey jealous, so dem kon gada aria boys wey dey waka about for market, take form gang to skata di town. Dem attack Jason house, bikos dem tink sey Paul and Silas dey der, so dat dem go bring dem out kon take dem go di town hall.
Wetin full dia mind na wikedness, evil tins, long-trot, bad belle, bad-bad tins; jealousy, to kill and fight, to lie, to keep enemy with pipol, to judge pipol waka,