Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 27:3 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

3 Even doh san and stone dey heavy, e nor still heavy rish di wahala wey foolish pesin dey kause.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 27:3
12 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

I curse dia wiked mind, bikos e too strong and dia annoyance, bikos e dey bad well-well. I go divide dem inside Jakob family kon skata dem among Israel pipol!


Na vexnashon dey kill who nor get sense and na jealousy dey kill fool.


Foolish pipol dey kwik vex, but wise men nor dey tok even wen dem curse dem.


E betta make wiked animal attack pesin, dan to listin to wetin foolish pesin dey tok.


So make yu let odas praiz yu, instead of yu to dey praiz yorsef.


Vexnashon bad and anga dey distroy tins, but who fit stand and bear jealousy?


King Nebukadnezzar vex well-well and en face kon dey red for Shadrak, Meshak and Abednego. Den e orda sey make dem heat di fire seven time, so dat e go hot well-well.


Wen di donkey si God angel again, e kon lie down for groun. Den Balaam vex kon beat di am with en stik.


Nor bi like Kain wey bi devil pikin, wey kill en broda. And wetin make am kill-am? Na bikos God nor asept en ofrin as E asept Abel own.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ