Jakob kon tell Esau, “My oga, yu know sey di shidren still small and I dey kare for di animals wey just born, if wi sey make wi travel with dem for just one day, all di animals fit die.
E still build towas wey e fence; dig many well for di desert, bikos e get many animals for di hills and plain land. E get pipol wey dey work for am for en farm, vineyard, di hills and for Mount Karmel, bikos e like farm work well-well.
All di nashon, make una hear wetin Oga God won tok, den una go-go tok about am for far land wey dey near di sea sey, “Just as shepad dey guide en sheep, na so too God wey skata en pipol, go gada and guide dem again.
just as shepad dey kare for dia sheep wey skata kon gada dem again. For dat day wen di wahala go start, I go bring dem kom back from where dem skata go.
Make una kare for di sheep wey God give una whole, just as shepad dey kare for dia sheep. Make e nor bi like sey dem force una do am, but na as God wont am. Una nor dey do am bikos of money, but na bikos una won do am.
Wen en senior broda Eliab hear am dey tok to di men, e kon vex tell David, “Wetin make yu kom der? Na who yu sey make e guide doz sheep for di desert? I know sey yu like to show yorsef! Yu just kom here to wosh di fight!”