Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 27:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 27:22
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

King Jeroboam for Israel nor still shange from di bad tins wey e dey do, but e kontinue to dey choose priest from ordinary family make dem kon serve for di altar wey e build. Na pipol wey just like to bi priest, e dey make priest.


Fero with all en savants and evribody for Egypt wake-up for nite bigin kry well-well, bikos e nor get any house where pesin nor for die.


Wen dem tell Fero sey Israel pipol don go, en heart and en savants heart kon turn against Israel pipol. So dem sey, “Wetin even make us do dis tin? Naw wey wi don free Israel pipol, na who go kon dey serve us?”


Di enemies sey, ‘I go porshu, katch, divide dia propaty kon take evritin wey I wont. I go distroy dem with my swod.’


Money na crown for wise pipol head; but foolish pipol work, dey only produce bad result.


Yu go sey, “Dem attack mi, but I nor wound! Dem beat mi, but I nor remember. ‘Wen I go take stand up for bed, so dat I go-go find anoda drink?’ ”


Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.


Israel pipol, wetin make una still wont make dem beat una? Una wont make dem ponish una pass dis ones? Sore don already full una head and una body don rotin finish.


Black man fit shange en skin kolour, abi leopard fit komot di mark wey dey en body? If dem nor fit, den e go hard for wiked pesin to do good, bikos na only to do bad tins, e sabi.


My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.


Wen Saul hear wetin happen to en men, e kon send anoda set go, but di same tin happen to dem too. So e send di third set go and dem kon join di rest dey tok like di profets.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ