All dis tins dey taya pesin and nobody fit shange or tok as dem bi: No matter wetin wi dey si and hear, awa eyes still won si and awa ear still won hear more.
E get one man wey dey stay alone, e nor get pikin or broda, but e dey work hard to get more propaty. But e ask ensef, “Na who I dey work for sef wey make mi nor dey fit enjoy mysef?” All dis tins dey yuzles well-well o-o!
True-true, wine go disgrace proud and wiked pipol! Dia mout wide like grave and just as deat nor dey beleful, na so too nor-tin dey beleful dem. Bikos of dia long-trot, dem don gada nashons kon swallow many pipol.
“Una dey put mind sey una harvest go plenty, but na small una dey get. Even wen una karry di small food wey una harvest rish house, I go blow dem trowey. Na wetin make mi do like dat? Na bikos my temple skata and all of una dey build fine-fine house for unasef.
bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.