1 Make yu nor boast about tumoro, bikos yu nor know wetin go happen between naw and den.
Ahab ansa, “Make una tell King Ben-Hadad sey, ‘Betta soja nor dey make mout until e fight en war finish.’ ”
Haman still sey, “Na wetin remain? Even di kween do party for di king and na only mi e invite to follow am and e still sey make wi kom back tumoro.
bikos na-im bi God. Wi bi en pipol and E dey wosh ova us, bikos na wi E dey kare for.
True-true, nobody know tumoro and nobody fit tell anoda pesin wetin go happen tumoro.
Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”
Bikos E sey, “I hear una for di rite time and wen di day for Mi to save una rish, I help una.” Si, na di rite time bi dis; na naw bi di day for salvashon!
God go give yu and Israel pipol to Filistia pipol. Tumoro, both yu and yor sons go dey with mi. God go still give Israel sojas to Filistia pipol.”