6 Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.
Nor allow lazy pesin work for yu, bikos e go bi like betta wine for yor mout or like smoke wey enter yor eye.
Na manaja wey nor get sense dey enter trobol, but betta manaja dey bring progress.
As kold wota dey sweet for dry sizin, na so too savant wey pesin fit trust, dey make belle sweet di pesin wey send am.
Make yu ansa fool akordin to en kweshon, so dat e go know sey e nor wise as e tink, but if yu nor ansa am, yusef go bi fool like am.
As pesin wey en leg cripple nor fit use am, na so too foolish pipol words dey yuzles.
But di men wey go with Kaleb kon sey, “No, wi nor strong rish to fight dem; di pipol wey dey der get pawa pass us.”