27 So, anybody wey dig pit for pesin go fall inside my ensef and pesin wey roll stone to wound odas, na di stone go fall kill-am.
So dem kon hang Haman for di pit wey e dig for Mordekai. Den di king kon stop to vex.
But Estha go meet di king and di king give orda make Haman use en own head karry di wiked plan wey e make. So dem kon hang Haman and en sons.
Wiked pipol dey porshu and ponish poor pipol. So make di evil trap wey dem set for oda pipol, katch dem.
My enemies don set trap for mi and I don taya bikos of dia wahala. Dem dig deep pit for where I dey waka pass, but na dem go fall enter by demsef.
Wiked pipol don fall enter di pit wey dem dig for odas. Di trap wey dem set, don katch dia own leg.
If yu deceive honest pesin kon make am do bad tins, yu go fall enter di trap wey yu dig by yorsef, but God go reward innocent pipol well-well.
Wiked man sins na trap, bikos na en own sin net, go katch.
Anybody wey dig pit for odas, go fall enter by ensef and pesin wey break wall pass, snake go bite am.
But evil pipol own don finish, bikos na wetin dem do pipol, God go do dem too.
Yes! Jerusalem pipol own don finish and Judah town don dey fall! Evritin wey dem dey tok and do, dey make God vex, bikos dem dey oppoz God law.