E get one man for Gilgal wey dem dey koll Sheba, na Bikri bi en papa wey kom from Benjamin tribe. E blow trumpet take koll di pipol kon sey, “Make David get out! Wi nor go follow am again! Israel men, make wi dey go awa house!”
Wen all Israel Pipol hear sey Jeroboam don kom back from Egypt, dem invite am kon make am king for Israel. So, na only Judah tribe kon dey obey David shidren-shidren.