16 Lazy pesin go tink sey en wise pass seven pipol wey get sense well-well.
Foolish pipol dey always tink sey wetin dem dey do dey korrect, but wise pipol dey listin to odas.
Pesin wey foolish well-well, betta pass pesin wey tink sey e wise, but e nor get sense.
My pikin, make yu dey wise and I go happy, so dat I go get good ansa to give anybody wey dey oppoz mi.
Lazy pipol, make una learn lesin from di way ant dey live dia life.
For una heart, make una make Christ una Oga God and make una ready to ansa anybody wey ask una about di hope wey una get.