Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 25:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 Wen yu stand for king front, nor try to impress am or pritend sey yu bi betta pesin,

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 25:6
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

My God, my heart nor dey proud; my eyes nor dey look anyhow. I nor dey worry mysef with matter wey too heavy for mi to bear.


But Moses tell God, “Na who I bi to go meet Fero or to karry Israel pipol komot from Egypt?”


E betta make yu dey honbol and poor, dan to join pipol wey dey karry body up kon follow dem share di propaty wey dem tif.


Just as too mush honey nor good for yu, na so too, to make pipol dey praiz yu well-well, nor good.


Nor let bad advisers near di king, so dat pipol go know am bikos e dey judge well.


bikos e go good sey, make en ensef tell yu to sidan for high pozishon, na sey make e gi-am to anoda pesin wey dey important pass yu.


So make yu let odas praiz yu, instead of yu to dey praiz yorsef.


But wen dem invite yu, make yu sidan for back chair, so dat wen di pesin wey dey do di party si yu, e go sey, ‘My friend, kom sidan for dis betta place for front.’ Den all di pipol wey dey follow yu chop, go give yu respet.


“Wen dem invite yu go party, nor rush go sidan for betta chair, bikos di pesin wey dey do di party fit don invite pesin wey big pass yu.


Samuel sey, “Even doh yu feel sey yu nor dey important, yu still bikom God pipol king. Na God choose yu as king ova en pipol.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ