Di king ask, “Nor bi Joab send yu kom? “Di woman ansa, My king, I use evritin wey dey holy take swear sey, e nor get how I go take dodge yor kweshon. Na Joab wey bi yor offisa tell mi wetin I go do and wetin I go tok.
make yu orda make dem search for di rekord wey yor grand-grand papa keep. If yu do am, yu go si sey, before-before, di town too like wahala and e don give kings, kingdoms and rulers, many trobol. Di pipol for der, dey hard to rule and na dis make dem distroy di town.
I don orda sey make dem find out and dem sey, na true sey Jerusalem dey go against royal authority before; na so-so trobol dem dey find and pipol wey nor dey obey di law, full der.
Naw, awa oga, if yu like, make yu orda for di royal rekord for Babilon weda yu go si if King Cyrus really give orda sey make dem ribuild di temple for Jerusalem and den, make yu tell us wetin yu si for dis matter.”
and I make up my mind to search and undastand evritin wey pipol don do for dis world. But I kon si sey, God don really give us betta work to do for dis world.
Na di Oga awa God get all di sekret tins, but di tins wey E tell us, na for wi and awa shidren-shidren forever, so dat wi go fit obey all di words for dis law.