19 Like tit wey dey pain pesin or leg wey don break, na so too e bi to trust pesin wey nor dey sirious wen trobol kom.
To sing for pesin wey nor get peace for mind, bi like sey yu dey remove en klot from en body wen kold dey or rub salt put for en sore.
Egypt pipol nor go fit help dem at-all and bikos of dis, I koll di land, “Nashon wey dey make mout, but dem nor get pawa.”
Una dey espect Egypt pipol to kom help una, but dat go bi like sey una won use soft stik take waka; but e go break kon wound una hand. Dat na how Egypt king bi to anybody wey put hope on am.” ’ ”
Di first time wen dem karry mi go kourt, evribody abandon mi and all of dem run leave mi. Make God nor judge dem bikos of wetin dem do!