16 Nor chop honey too mush bikos e sweet, so dat yu nor go vomit, bikos yu too chop am.
Yu go vomit all wetin yu don chop, den all di praiz wey yu praiz am, nor go mean anytin again.
Make yu nor dey too visit yor neighbour, bikos dem fit taya kon hate yu.
Just as too mush honey nor good for yu, na so too, to make pipol dey praiz yu well-well, nor good.
So make yu nor dey too good or too wise, if not e go distroy yu!
Na milk and honey e go dey chop and dis food go help am know how to rijet evil and choose wetin dey good.
dem go still produce enough milk for am. Yes! Di few pipol wey go survive go si plenty food chop.
“So, make una shine una eye! Nor let party and wahala for dis life full una mind, if not, dat Day go kom wen una nor espect,
Make una nor dey drink strong drink, bikos e go distroy una. But make una allow God Spirit fill una mind.