13 As kold wota dey sweet for dry sizin, na so too savant wey pesin fit trust, dey make belle sweet di pesin wey send am.
Na manaja wey nor get sense dey enter trobol, but betta manaja dey bring progress.
tish yu wetin trut really mean. So if dem send yu go find am, yu go bring korrect ansa kom back.
To hear good news from land wey far, bi like wen pesin pour kold wota or drink for en body.
Just as if pesin kut en own leg komot, na so e bi too to send fool message, bikos na trobol di pesin dey look for.
Finehas wey bi Eleazar pikin, di priest and di leaders kon leave Reuben tribe, Gad tribe and half of Manasseh tribe for Gilead town kon go ripot give di whole Israel wey dey Shiloh for Kanaan land.