11 Bikos betta words wey dem tok well, bi like gold wey dem take dekorate silva.
Yor words don support pipol wey won fall and yu don give strent to doz wey don taya.
Evribody dey like good ansa, but e dey good to tok di rite tin for di rite time!
bikos, honest ansa na good sign for true friendship.
If not, evribody go know sey yu nor fit keep sekret and yu nor go ever forget di shame wey go katch yu.
Di tisha kon try to find good words wey go make us know di trut;
God wey get pawa don tish mi wetin I go tok, so dat I go fit make pipol wey dey weak, strong. Evry morning, I dey-dey happy to hear wetin God dey tish mi.
As good pesin dey bring good tins from en heart, na so bad pesin dey bring bad tins from en heart too.
Den David kollect di gifts kon tell Abigail, “Make yu go back to yor house in peace. Bilive sey I don hear wetin yu tok and nor-tin go happen to una.”