10 If not, evribody go know sey yu nor fit keep sekret and yu nor go ever forget di shame wey go katch yu.
Di tins wey dey make mi fear, make Yu take dem komot from my life, bikos yor law dey good.
Bikos betta words wey dem tok well, bi like gold wey dem take dekorate silva.
If yu and yor neighbour dey argue about sometin, e go good make una setol am between unasef and make yu nor tok about una sekret for publik.
To get good name betta pass perfume wey dear well-well and di day wen pesin die, betta pass di day wen dem born am.