8 If yu dey always plan evil, na trobol-maker dem go dey koll yu,
“Yu know all di wrong tins wey yu do David, my papa. Naw, God go ponish yu.
Aldo dem plan against Yu, dia wiked plan nor go work.
If yu plan to do bad, yu go lost; but if yu plan to do good, yu go get love and faithfulnes wey nor dey fail.
bikos na only trobol dem dey always tink about and anytin wey dem tok, dey kause wahala.
bikos anytin wey foolish pesin plan, dey make pesin sin and pipol nor like pesin wey dey laf odas.
Na bad plans full dia heart and na so-so trobol dem dey kause.
pipol wey dey always tink bad tins; pipol wey dey rush to go do wiked tins;
Na so-so wiked tins pipol wey dey deceive odas dey tink and na di wiked tins wey dem won do to poor pipol, dem dey always dream about, even wen di poor pipol dey do wetin dey rite.
Na who bi dat wiked pesin for Nineveh wey dey plan against God?
to tok bad about odas and hate God. Dem dey karry body up, dem nor get respet and na bad tins full dia mind. Dem nor dey respet dia papa and mama.