Foolish pipol dey tok anyhow and na wikedness full dia mind. Tins wey God nor like, na-im dem dey like to do and dem dey tok yuzles tins about di Oga awa God. Pipol wey dey hongry, dem dey make hongry kill dem more and doz wey nid wota, dem nor dey gri give dem wota drink.
Una sin and all di bad-bad tins wey una do, I know as dem bad rish. Una ponish good pipol; dey take bribe and nor allow poor pipol get korrect judgement for kourt.