6 So make sure sey yu plan well before yu go fight and di more dem advise yu well, di more yu go dey win.
E do bad-bad tins for God eye just like Ahab, bikos wen en papa die, di pipol wey dey gi-am advise kon make am sin well-well.
Any nashon wey nor get who dey guide am, go fall, but wen doz wey dey give yu good advise many, yu go prosper.
Plans dey spoil wen good advise nor dey; but many advise dey bring progress.
Make yu dey sure sey dem advise yu well, before yu make any plan or go start war.
“Abi wish king wey won go fight anoda king, nor go first sidan tink weda di 10,000 men wey e get go fit fight di 20,000 wey di oda king get?
I don fight di good fight for di faith wey I get; I don run di race finish; I don do wetin I promise sey I go do.