34 but make yu remember sey, as yu dey sleep, poverty go kom attack yu like tif.
Lazines go make yu poor, but hard work go make yu get money well-well.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
Lazy pesin bad like pesin wey dey distroy tins.
Make yu sleep and rest as yu like or fold yor hand and rest small,
Dis na some of Solomon oda wise words and na King Hezekaya men for Judah kourt, rite dem down.
Farmer wey dey work hard, get plenty food to chop, but pipol wey dey waste time for evritin wey dem dey do, na poverty go kill dem.
E go sey, “Make I just sleep; fold my hand and rest small.”
But as e dey sleep, evritin wey e get go vanish like sey na tif karry dem go.