30 Wen I waka pass foolish and lazy pesin farm and vineyard,
If yu go gri listin, I go esplain give yu. I go ansa yu from wetin I know.
But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.
Job, wi don study dis tin wey dey happen and wi know sey na true. So, hear dis words make yu use am for yor own good.”
Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy, while wiked pipol go shut up dia mout.
Bikos since wen I dey yong kon rish naw wey I don old, I neva si God leave doz wey dey fear am or allow dia shidren go beg for food.
If pesin get sense, e dey show wen e dey tok, but if yu dey foolish, na stik dem go take beat yu.
Pesin wey dey work hard, always get plenty to chop, but pesin wey dey porshu dis world tins, nor get sense.
Lazy pipol won get plenty, but na small dem dey get, while doz wey dey work hard, dey prosper.
But man wey dey sleep with anoda pesin wife, nor get sense at-all and e just dey distroy ensef by ensef.
Na so too, wen pesin too lazy to ripair en house, wen en zink dey leak, di house go fall.
I don si evritin for dis yuzles life; good yong pipol wey kwik die before dia time and wiked pipol wey dey get long life.