29 Nor boast sey, “I go do am back wetin e do mi. Yes! I go deal with am well-well.”
Nor do bad to pesin wey do yu bad, but make yu trust God and E go save yu.
Make una dey sure sey nobody pay bad for bad, but for evritime, make una always dey do good for each oda and for evribody.
So 3,000 men from Judah go di kave for di rock for Etam, go meet Samson kon tell am, “Yu nor know sey na Filistia pipol dey rule us? Wetin yu do to us so?” Samson ansa dem, “I pay dem back for wetin dem do mi.”