Make doz wey dey wise, undastand dis tins. Make doz wey get sense, listin well-well. God ways dey true and e dey rite too and pipol wey dey raitious, dey follow am as dem dey live dia life. But doz wey dey sin, go stagga fall.
“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.
Make una nor favor anybody and na as una take listin to rish man kase, na so too una go take listin to poor man own. Make una nor fear anybody, bikos na God dey judge evribody. Any kase wey una nor fit judge, make una bring am kom meet mi.’ ”
Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.