1 Make yu nor jealous evil pipol or try to make friend with dem,
God go bless di pesin wey nor dey follow wiked pipol advise, dey waka with sinnas or sidan with aproko pipol!
Make Yu nor let mi sofa with my enemies and nor kill mi with wiked pipol.
Make yu nor worry yorsef about wiked pipol wey dey prosper or jealous doz wey dey do bad tins!
So, make yu wait for God with patient! Make yu get mind as yu dey wait am! Make yu nor worry about wiked pipol wey dey prosper or fear, bikos of wetin dem get.
bikos I dey jealous proud pipol wen I si dem dey prosper, even doh dem wiked.
Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
Make yu nor jealous sinnas, but make to dey fear God, bi di only tin wey koncern yu for dis life.
Make yu nor fear doz wey dey do evil and make yu nor jealous wiked pipol at-all,
Nor jealous or bigin bihave like pipol wey like wahala well-well,
Nor go where wiked men gada put or follow wetin dem dey do.
Nor do or go near bad tin! Make yu rijet am kon go yor way.