Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 23:35 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

35 Yu go sey, “Dem attack mi, but I nor wound! Dem beat mi, but I nor remember. ‘Wen I go take stand up for bed, so dat I go-go find anoda drink?’ ”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 23:35
11 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Yu go bi like pesin wey sleep near river or on-top boat for wota.


Just as dog dey go back go chop en vomit, na so fool dey always show en foolishness.


Even if yu beat foolish pesin almost die, yu nor go fit beat en foolishness komot for en body.


But instead, una bigin laf and dey do party. Una sey, “Make dem kill sheep and melu make wi chop and make wi drink plenty wine! Make wi drink and chop, bikos wi go fit die tumoro.”


Dem go sey, ‘Make wi buy some wine and drink as wi like! Tumoro go betta pass today and wi go get evritin wey wi wont!’ ”


I hear Israel pipol dey tok with pain sey, “Oga God! Wi bi like animal wey dem nor train, but Yu don tish us to dey obey. So make Yu bring us kom back, bikos wi dey ready to kom meet Yu di Oga wey bi awa God.


My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.


Dem dey do wayo, dey give dia body to yeye tins; tins wey nor dey pure and dey wiked.


“Make una make sure sey nobody among una wey dey hear dis tins today, bilive sey evritin dey okay with am, even doh e nor dey hear pipol word. Dis kind tin go skata all of una, weda una dey good or bad.


Na dem bi ezample for dis word wey pipol tok, “Dog dey go back go chop en vomit,” and “Pig wey dem don wosh en body, go still go liedan for portor-portor.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ