25 Make yu do wetin go make yor papa and mama happy for yu, so dat yor mama nor go regret sey e born yu.
Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.
Foolish shidren dey kause pain for dia papa and dia mama go dey regret.
My pikin, if yu dey wise, I go happy well-well.
My pikin, listin well-well and make my life bi ezample to yu.
My pikin, make yu dey wise and I go happy, so dat I go get good ansa to give anybody wey dey oppoz mi.
En neighbour and rilashons hear sey God don do big tin for am, so dem kom happy with am.