Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 23:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 Make yu do anytin to get wisdom, trut, undastand and good sense and if yu get dem, make yu nor sell dem, bikos dem go help yu well-well.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 23:23
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

True-true, I love yor kommand pass gold and I even love am pass di gold wey fine pass.


Yor kommand dey good to mi pass plenty silva and gold.


Dis na di wise words wey Solomon tok: Shidren wey wise dey make dia papa proud, but fools dey kause pain for dia mama.


E betta well-well to get wisdom and undastandin, dan to get gold and silva.


Foolish pesin nor get time to spend en money to get wisdom, bikos e nor undastand wetin wisdom bi.


Wise pesin dey always look for knowledge and en mind dey find wisdom.


So, nor ever korrect proud pipol, bikos dem go hate yu; but if yu korrect wise pesin, e go respet yu forever.


God sey, “All of una wey wota dey hongry, make una kom drink from dis wota! Una wey nor get money, make una kom chop! Make una kom drink wine and milk and una nor go pay anytin!


“God Kingdom bi like gold wey dem beri for field. One pesin wey si am, kon hide am. With happiness, e go sell evritin wey e get buy di land.


Wen e si one gold wey dear well-well, e kon go sell evritin wey e get buy am.


Wetin pesin go gain, if di whole world bi en own, but e luz en soul? Or wetin pesin go fit give take pay for en soul?


escept sey di Holy Spirit dey warn mi sey, from town to town, na prison and sofa dey wait for mi.


E feel sey e betta make dem laf am, bikos of di Mezaya wey dey kom, instead make e dey enjoy di fine-fine tins for Egypt. E do like dis, bikos e put en eye for God reward.


God pipol don win Satan with di Lamb blood and with di word wey dem tok about Christ. Dem nor too kare for dia life, so dem even dey ready to die.


So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ