Proverbs 23:21 - Holy Bible Nigerian Pidgin English
21 bikos pipol wey dey drink and chop too mush, go soon luz evritin. So, If all wetin yu dey do na to dey chop and sleep, den yu go soon start to wear rag.
Una wey dey drink anyhow, make una wake-up bigin kry. Una wey dey drink wine, make una kry; bikos dem don distroy di grape and all una sweet wine don finish.
But wen Man Pikin kom, e chop and drink and una sey, ‘Si am, long-trot, drunkaman, tax kollectors and sinnas friend!’ But God wisdom dey show for wetin e dey do.”
But naw, I dey rite to una sey, pipol wey sey dem bi Christians and dem dey do bad tins, make una nor follow dem make friend. Make una nor even chop with dat kind pesin.
bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.