24 Make yu nor make friend with pipol wey get hot and bad tempa,
Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.
Pesin wey dey kwik vex, naim dey first kause fight; but kwayet pesin dey kwayet for evriwhere.
Pesin wey dey karry body up and do wayo, nor dey kare about oda pipol.
Pesin wey get hot tempa dey kause kworel and pesin wey dey kwik vex, dey sin well-well.