2 Pesin wey get plenty money and pesin wey nor get, na di same dem bi, bikos na God kreate two of dem.
Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.
E nor dey support rulers or rish pipol against poor pipol, bikos na-im kreate all of dem.
Doz wey dey opress poor pipol, dey kause God wey kreate dem, but to help poor pipol, na to honor God.
Just as God give eye to poor pesin, na so too E give eye to pesin wey dey opress oda pipol.
So, di eye nor go fit tell di hand sey, “I nor nid yu” and di head nor go fit tell di leg sey, “I nor nid yu too.”
E dey make some poor kon make odas rish. E dey honbol some kon make odas great.