bikos word wey wise pesin tok, bi like di sharp stik wey shepad dey use and wise words bi like word wey dem nail well for wall and na God bi di Shepad wey give us all dis tins.
So I try to search evriwhere to get wisdom and to undastand why tins dey happen di way dem dey happen and I dey ready to prove to mysef sey, wikedness dey stupid and foolishness dey bring madness.
My pipol, make una open una ear as una dey kom meet mi; make una kom meet mi and una go get life! I go give una kovenant wey go last forever kon give una di blessings wey I promise David.