15 Shidren nor dey know sey di way dem dey bihave nor good, but betta korreshon go tish dem how to bihave well.
No klean tin fit kom from wetin nor klean like human being.
Si, na for inside sin, dem born mi; Yes! Na rite from di time wey my mama get my belle.
Doz wey nor dey korrect dia shidren, hate dem. But doz wey love dia shidren, dey always korrect dem with love.
Train yor pikin well wen dem still dey yong to learn; if yu nor do like dat, yu dey help dem distroy dia life.
Korrect ponishment dey drive evil komot from pesin mind kon make en heart klean.
To dey beat and korrect shidren, good well-well, bikos if dem dey do anytin wey dem like, dem go make shame katch dia mama.
Korrect yor shidren and yu go dey proud of dem, bikos dem nor go make yu shame at-all.
Wetin flesh born, na flesh e bi, but wetin God Spirit born, na spirit e bi.
All of us dey live dis kind life before. Wi dey do difren tins wey awa body and mind wont. Dat time, wi bi shidren wey God won ponish like oda sinnas.