12 God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans.
But Elisha sey make dem go tell Israel king sey, “Make yu nor pass thru dis place, bikos Siria king go attack der.”
E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
But wi pray give awa God kon put men wey go dey guide di place both day and nite.
Na trut dey guide yu if yu dey good; but pipol wey dem nor fit trust, na dia own wayo dey distroy dem.
Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend.
Lazy pipol dey always sey, “Lion dey outside and e go kill us”, so dem nor go gri go out.
but if na from God, una nor go fit stop dem, escept una won fight God.”
Den evribody go know who dis wiked man bi and God go distroy am with breeze from Christ mout kon beri am with di glory wey dey kom.