11 Pesin wey get klean heart and always dey tok well, di king go always bi en friend.
Na Natan pikin, Zabud bi shief to di difren govnor.
So Mordekai wey bi Jew kon bi next to King Zazes. En pipol wey bi Jew dey respet, honor and like am well-well. E work make e for good for en pipol, so dat dia shidren-shidren nor go sofa.
I go favor di good pipol wey dey di land and dem go kom stay with mi. Na only doz wey nobody dey tok bad about, go serve mi.
Na only doz wey get klean hand and pure heart; pipol wey nor dey serve juju or lie or do bad tins.
Na yu fine pass among evry oda man! Betta word dey kom out from yor mout and bikos of dis, God ensef don bless yu forever.
Just as king dey happy for en wise savant, na so too e dey vex for doz wey disgrace am.
Kings dey always won hear di trut and e go favor doz wey dey tok am.
God dey protet doz wey dey tok trut, but doz wey dey lie waka, E dey distroy dia plans.
Wise pesin word dey favor am, but fool own, dey distroy am,
So Nebukadnezzar kon promote Shadrak, Meshak and Abednego.
God go bless una wey get pure heart, na una go si God.
Evribody dey tok good about Jesus, dem sopraiz for di sweet-sweet word wey dey kom out from en mout. So dem kon ask, “Dis nor bi Josef pikin?”