Pesin wey dey buy sometin go sey, “Dis tin too dear! E too dear!” But afta e don buy am, e go-go make mout sey “Dis tin wey I buy so, cheap well-well.”
Di first one na: Help mi make I nor dey lie and deceive pipol and di sekond one na, make Yu nor make mi too rish or too poor! Make yu give mi di tins wey go rish mi use.
Pesin wey dey make money with wayo, bi like bird wey dey hash egg wey e nor lay. Wen e don dey old, e go luz all di money wey e get, den e go know sey e bi fool.”