3 Instead of sakrifice, make pesin do wetin good and korrect; tins wey go make belle sweet God.
Den I sey, “Look, I don kom, just as dem rite about mi for yor Book sey:
I nor dey komplain about una sakrifice or di burnt ofrin wey una always dey offa.
God hate wiked pipol sakrifice, but E dey enjoy good pipol prayers.
Nor bi animals sakrifice I wont, but na una love wey nor dey die. E betta make my pipol know mi, dan all di burnt ofrin wey dem dey give mi.
“Oga God wey dey rule evritin sey, ‘Make una dey judge well, show kindness and sorry for odas.
To love God with all awa heart, mind and pawa and to love awa neighbour as awasef big pass all di sakrifice and ofrins wey pesin fit give God.”
Den Samuel sey, “Na wish one God like pass: to obey am or to offa ofrin and sakrifice? E betta to obey dan to sakrifice di best sheep gi-am.