My God, shebi na trut Yu wont? But even wen Yu ponish dis pipol, dem still nor gri shange and wen Yu nearly distroy dem, dem nor gri take korreshon. Dia heart strong like rock and dem nor won turn from sin kom meet Yu make Yu for forgive dem.
Dem dey shame sey dem do dis kind wiked tins? ‘No!’ Dem nor dey shame at-all; dem nor even sabi form sef! Bikos of dis, just as pipol wey don die, na so too dem go die finish afta I don ponish dem.” Mi, wey bi God, don tok.
So God sey, “Make una tink about wetin bin dey happen to una before una start to ribuild di temple. But from naw go, evritin wey una dey do, go dey okay.