28 Pipol nor dey bilive anytin wey lie-lie pesin tok, but pesin wey dey tink before e tok, dem dey bilive en word.
“Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.
Trut go last forever, but lie-lie nor dey tey before evribody go know sey na lie.
If yu bi lie-lie witness, dem go ponish yu and yu nor go fit eskape.
Anybody wey tok lie for wetin e nor know, nor go fit eskape ponishment and na di lie go kill-am.
To lie for pesin head bi like to kill pesin with swod, wound am with sharp arrow or shot am.
doz wey dey lie for anoda pesin head and pipol wey dey kause trobol among dia friends.”
Dem ansa di girl, “Yu nor know wetin yu dey tok!” But di girl still dey sey na Pita, so dem kon sey, “E go bi en spirit!”
But as e bi sey wi get di same spirit wey dey give faith, just as dem rite sey, “I bilive; naim make mi dey tok.” So wisef bilive, naim make us dey tok too.
Dis word wey I dey tok so na trut and I wont make yu make sure sey evribody wey trust God dey do good. Dis tishing dey good and e go help evribody.