God sey, “Una wey wont make dem save una; una wey dey kom meet mi make I help una. Make una tink of di Rock wey una from kom, di place where dem from kut una from.
So my friends, make una dey strong and nor let anytin shake una. Make una always dey do God work, bikos una know sey, evritin wey una do for God, get gain.
Nor bi sey I don get evritin wey I wont or God don make mi pafet, but I dey try make I get di prize wey dey kom from God kon hold am as Jesus Christ whole mi.
But yu wey dey serve God, make yu nor put hand for all dat kind tin. Instead, make yu dey struggol to do wetin dey rite and good; dey keep yor promise; dey love; get patient and dey gentol.
Make yu run from doz tins wey dey hongry yong pipol to do, so dat yu go please God forever. Den yu go fit love and stay for peace with odas wey dey serve God with klean heart.
Dis kind sofa go show sey una faith na really one. Gold wey go spoil one day, dem still dey test am for fire, tok-less of una faith wey get value pass gold and e go bring praiz, glory and honor wen Jesus Christ go kom.