E still good wen God bless yu with money, propaty and good health wey yu go take enjoy dem. To enjoy yor work and asept di life wey God give yu, na big gift from God.
But e get ten men for di group wey tell Ishmael sey, “Abeg! Make yu nor kill us! Wi get wheat, barley, olive oil and honey wey wi hide for farm.” So e nor kill doz ones.
Wen pesin dey good, na di good tins wey dey inside am, dey make am bear good fruits, but bad pesin, na di bad tins wey dey inside am, dey am make bear bad fruits, bikos na from wetin full inside pesin mind, naim en mout dey tok.