19 E betta to stay desert dan to stay house with wife wey dey komplain well-well.
Foolish shidren fit distroy dia papa and mama, na so too, wife wey dey komplain well-well, bi like rain wey dey drop small-small.
E betta make yu stay on-top house dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
Wife wey dey komplain well-well, bi like wota wey dey drop small-small for rainin sizin;
woman wey pipol nor like wey kon marry and savant girl wey kon take en madam pozishon.’
I wish sey I get where I fit go stay for desert; I for go, so dat my pipol nor go fit si mi, bikos dem nor dey faithful to God.