Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Proverbs 21:16 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

16 Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Proverbs 21:16
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

but make Yu ponish pipol wey dey do bad tins. Ponish dem with all di oda wiked pipol. Make peace always dey Israel land!


Just as sheep dey waka like mumu, na so too dem go dey waka until dem enter dia grave; di place where Deat go bi dia shepad and oga. For morning, pipol wey dey fear God go rule ova dem. Dia body go rotin for grave wey nor even dey near dia fine house.


Anybody wey ready to live rite, go get life; but pesin wey sey na bad tins e like to dey do, go die.


Follow who get sense waka, so dat yu go get sense too; but if yu waka with foolish pipol, na trobol go follow yu.


Keep God kommandment and yu go get long life; but yu go die, if yu nor follow dem.


From pipol wey live good life before dem bigin do bad-bad tins;


E go die bikos e nor fit kontrol ensef. Na en yeye life go send am go en grave.


Doz wey fall for en trap nor know sey, anybody wey enter en house go die and doz wey don already enter don die since.


“But if one good man stop to do good kon dey do bad and wiked tins wey bad pipol dey do, yu tink sey e go live? No! Dem nor go remember any good tin wey e do. E go die, bikos e nor gri obey my law and e dey sin.


I go distroy doz wey bin dey woship mi, but nor dey woship mi again. Dem nor dey ask make God guide or bless dem again.”


Before-before, na sturbones and sin dey kontrol una life,


My raitious pipol go live and bilive, but if anybody turn back, I nor go dey happy with am.”


Na from us dis pipol from komot, but dem nor really dey God family before, bikos if to sey dem dey, dem for stay with us. But dem live us, so dat evribody go know sey dem nor bi awa own.


Wen dis pipol dey follow una chop di fellowship food wey God don bless, dem bi like shuku-shuku for una body. Dem bi like shepad wey nor dey shame, bikos e kare for only ensef. Dem bi like kloud wey just dey blow, but rain nor dey fall. Dem bi like tree wey nor get fruits and God don rut dem komot from groun.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ