15 Good pipol dey happy wen dem give korrect judgement, but wiked pipol hope dey die.
Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am.
I go obey yor laws and I nor go forget yor word.
If to sey yor laws nor keep mi with joy, I for don die with my pains.
‘My God, I won do wetin Yu wont, bikos Yu rite yor laws for my heart.’ ”
God dey protet pipol wey dey tok trut, but doz wey dey do bad tins, na distroshon bi dia own.
God wey dey raitious know all wetin dey happen inside wiked pipol house and E go distroy dem.
Pesin wey nor gri asept wisdom, go die kon go where dead body dey.
My pikin, why yu go-go give yor love to anoda woman? Wetin make yu like di way anoda man wife bi?
So I gri sey, e nor get anytin wey betta rish to dey happy and enjoy yorsef as far as yu dey alive.
Yu dey help pipol wey dey do wetin dey rite; pipol wey remember how Yu wont make dem dey live dia life. But wen wi kontinue to dey kommit sin, Yu vex for us. So na how wi wont make Yu take save us?
Dat time, I go sey, ‘I nor know yu. Make yu komot from where I dey, yu wey wiked well-well.’ ”
Jesus kon tell dem, “My food na to do wetin my Papa tok and make I finish di work wey E send mi.
I dey like to obey God law with my whole mind,