10 Wiked pipol dey always like to do wiked tins, so dem nor dey pity for anybody.
Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor.
Instead of dem to dey sleep for nite, na bad tins dem dey plan. Wetin dem dey do nor dey good. Dem nor even dey try to turn from dia wiked ways.
Pipol wey bi tif dey jealous wetin odas tif, but wetin raitious pipol get, dey rish dem, bikos dem dey work for dia own food.
Na sin for yu nor to respet yor neighbour, but doz wey dey help poor pipol, na blessing go follow dem.
and dem dey happy to do yeye and wiked tins.
If yu nor gri listin to poor pipol kry, dem nor go hear yor own kry for help.
E betta make yu stay on-top house dan to stay with wife wey dey komplain well-well.
Nor ever plan bad against yor neighbour, bikos doz wey dey stay near yu, trust yu.
Naw, all dis na ezample for us, so dat wi nor go do bad tins as dem do,
Judgement nor get mesi for anybody wey nor dey mesi for odas, bikos mesi betta pass judgement.
bikos evritin wey dey inside di world (tins wey human being body wont; tins wey dey hongry pesin to get and to dey karry body up), nor kom from di Papa, but na dis world dem from kom.